VERSE 1 :: Eedris
Dem say I fight 50 cent
See their mouth dem just dey yarn anyhow
Dem say I run go exile
If Mr president catch you, e go flog you
For your information,
me met Mr president one on one inside Aso Rock
Dem say I no go make am again [na lie]
Dem say I ain't gat no game
Kennis music am back again
Kekeke, D1
Dem say I no like government
Bcos dem treat my people anyhow
Dem say dem no give me show
Dem wan see how rude boy wan survive
Me travel to america and canada
asia, caribbean, south africa
men u no so BMG, we doin it right
Now am back home lacream we kicking it tight
For my fans wey love me
I thank you well well
Eedris is back again
CHORUS
papa di popo, papa koleyewon o
popo di papa, papa koleyewon o
papa di popo, papa koleyewon o
popo di papa, papa koleyewon o
Ijeta lari raa (x4)
VERSE 2 :: Eedris
Dem say I jagajaga
I yamayama, I scatter scatter
I too get wahala fa
My people suffer suffer
We still dey buy water
When I talk dey say who give me mouth to talk
When I yarn dey say who give me mouth to yarn
50 cent na my man you know we kicking it tight
Charly boy and PMAN, you know dey stab me for back
Mr Star, you know na we dey drink the beer
If I like, I go turn green to black
I go make peace with star
I go do how I like
Don't blame me style
Everybody get him mouth, you get your mouth to yarn
2face get him mouth, him get him to yarn
2face wan be like Obasanjo oh oh oh oh
Me I wan be like Fela Anikulapo Kuti
REPEAT CHORUS
[lyrics from www.niglyrics.com]
VERSE 3 :: Ruggedman
Dis na the unexpected collabo
Ruggedman and Eedris Abdulkareem [koleyewon o]
what we done, none can stop it
clubs we rock it
we drop shit, but none can flush it
dust na dust, that's easy to comprehend
no be magic say me and my nigga decide to blend
na message we dey try to send to the people
we need peace to move on even if we no be equals
[Politicians and people and government]
Look pass the money you wan eat and see the problems
face of the masses abi you need glasses
on the street go teach lessons
you wan loan the classes
do the right thing before water pass garri
before guns turn to wetin everyman dey wan carry
everyday for the thief one day for the owner
guess who be the thief and who be the owner.